Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fake life in naija
by
Y3shot
on 22/11/2023, 07:48:27 UTC
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
People like this don believe say na with fake like this they fit meet up. Bit this is a useless lifestyle faking a life and claiming wetin you be, instead of living a fake life it is better to work hard and get something real that you can prove people it was earned from you. People who dey live fake life to impress people I still dey wonder how long they want lieve this fake life, if they wan live this their fake life forever, it is impossible because living fake like get it own consequences because e dey later backfire.  Giving people that you have it all is making them that you are okay with all you have and when you go need help from people them fit no reason you again.