This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street...
Dat wan enta BlessingCEO well for body. She go use persin house pose as the owner for social media and the real owner go arrest her. The worse part be sey na most of those people wey our youths dem dey worship as their role models dey do dat type of thing pass. Borrow pose. Dat attitude crisscross d entire human race, nor be only Nigerians dey do am. For me, anybody wey dey do am nor be principled person. In fact, the persin na mumu because im suppose sabi sey e nor good to lead ur life to please anyone.