Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fake life in naija
by
Youngkhngdiddy
on 22/11/2023, 13:01:46 UTC
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
   Fake life na normal life for this country ooo. Everybody dey try impress everybody. Person go jus dey try live above him means, which dey very wrong. Girls especially, na Dem get hands for this kain thing, Dem wan be like, Dem wan feel among, you borrow everything for party wey nothing comot or to go catch man by deceit, the same man wey go follow catch you by deceit too. Sometimes peer pressure dey responsible for the fake life because why on earth would someone wey no hold wan dey act like say him hold. This country no dey better, people dey struggle to live through their normal life, na him person go just stay decide say him wan live the life wey big pass am.
   We go hear say oga travel, leave house for gateman to look after, gateman get mind, call him irresponsible and unreasonable girls, lie to them say na him get am, sounds funny but na reality. Normally you dey try eat the little food wey you get for house, but as a guy wey dey expect girl, you go come go above your means to impress girl wey nothing fit comot wey you no even know if she too dey follow chop your normal routine for house. As a girl, you comot with man con use am as an opportunity to rip the guy apart financially, all because you wan show say class dey. E dey better to really dey contented o because if the economy no kee people for the country, na the thing wey yoruba people dey call "ojukokoro" go kee Dem.