Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party, pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people. Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street, you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
My brother no be small thing they happen for this country, nothing way we never see again for the country you go see person way never eat since morning go dey claim say food fool kitchen just to cover up,e get one of my nelbour way jus dey deceived insef say na person way in dey deceived.