Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fake life in naija
by
HajiBagi
on 22/11/2023, 21:47:10 UTC
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.


All this thing's na fake life we dey call am, everybody no wan make them see am as them no get anything in life and this thing dey lead make person no achieve anything in life because even your destiny helper go pass you commot go give waiting belong to you to another person, and people that always do all this kind thing came from poor family and they will be forming big boy and big girl, this even remember me now about one of my guy wey  dey date one girl like this, the girl get swag even if you see her you go fall, this girl set and she is acting like one kind girl that her father is Mr president, my brother at the end na from poor family this girl come from Grin, my guy really want to end the relationship because of the lie but at the end they settled, this kind they affect many people relationship and still yet they still continue but from my observation I don't think this fake life for naija go end.