Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fake life in naija
by
Samlucky O
on 23/11/2023, 05:49:29 UTC
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
That one don turn habits among Nigeria people. But mostly girls. Because I no see reasons to why man dey borrow clothes because men nu get time to inpress wonan but rather women borrow to inpress man. If man borrow clothes to inpress woman na big fish e wan catche.

This thing dey dey common for Lagos. Lagos people dey like p ackaging like mad. but for me I see no need to borrow clothes dey try inpress person because who wan help you fit see am say you get and see as say wetting em wan give you, say you no go fit like accept am based on your level, not knowing say nothing gum you.

The only place I fit support say make we borrow clothes, na when we dey apply for some contract, wey require you to look sharp and financially capable of doing or handling the job. Because if you no get that character of packaging sometimes you fit loose contract wey you dey find. Like me the first time I applied for job wey I learn and the work I never do am for any company I like say I don work for here and there with proof. Because I no say I Sabi the job but just need alot of reasons to prove to them say you Sabi wetting you dey talk otherwise you no go fit get am. Sometimes previous experience dey always come as a question to who dey find job and if you hold your mouth tight you don Jones.