Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of learning a skill before gaining admission into the universIty
by
Stable090
on 23/11/2023, 22:04:31 UTC
My country pipo e go really make sense if you wey they seek for admission into the university learn at least skill wey fit fetch you income the reason why some of us find am hard in school na because we no learn handwork (skill) so the thing come become very difficult to even concentrate properly some days wey nothing day no food no money to go class go worry you and all this things really dey discourage somebody well well,
Hand work na better thing wey person need learn ooo, and e still dey pain me uptill now say I no learn any hand work, as I Small that time, I no wan learn any work, I dey claim fine boy that time, I never sabi Wetin life be then, I dey carry free food dey chop, dey play around, I no dey reason anything, if I know i for don find something learn that time. I sabi people wey be say time wey I dey school, na the hand work wey dem learn, na Wetin dem dey use pay school fees,  and na Wetin dem dey use survive for school be that, anybody wey get opportunity learn hand work make him carry am serious ooo, even after school you go still dey use am chop, dis one wey work no dey dis country like dis, hand work really dey important.