People go cry, some go faint many fit even die but nothing changes say this na big possiblity and every one dey aware so life go continue as normal and many people sef already get many things wey dem dey go so Bitcoin no be all and all for person. Abi you don forget say change na constant for this life wey we come as the world has been existing before Bitcoin and people have been living and so will people continue to the next advancement and adapt to the changes wey dem around for the surrounding.
Truth of the matter be say if bitcoin crash, na there you go see people wey dey talk say put what you can afford to risk, na dem go even cry pass because e no get anything like what you can afford to risk, money na money e go get how small e be, e go still pain you if you loss am anyhow. Beside every since we dey hear of DCA, abi the DCA way you dey do na N10 you dey put

If this kind of thing happen na everybody e go pain na that time you go take understand the meaning of "little drops of water makes the might ocean"