Username: Mantumbtc
Gender: Male
State: Rivers State
Greetings my follow Nigerian, I am a new person in this forum.so I want to inform you all. If there's anyway to help me, I'll appreciate.
Username: Grace333
Gender : Female
State: River state
Skill: hair dresser
My fellow country people I greet oo
I dey very happy to see say people for this site dey jam pidgin like this, na person introduce me to this forum and as e don be, I believe say I go get enough knowledge from my senior dem wey don dey for this forum tay tay.
Anyway thanks to you all, and compliment of the season.
I dey very happy to dey see new people for the forum wet be our own, I know say for the first time here everything go dey confusing to una but make una take una time dey read because for this community na who dey read go learn and who dey learn na e go grow as many of us wet you dey see here start the way wey una start. Nobody come here become full member or legendary under one day because magic no dey here. He go make sense make una read the people thread and also do una own research to make una understand wella. Post less and read more at this your stage and no think say to rank up na competition or by force so that make you no go do plagiarism because that na e go make them ban you for here. Forum get security and police just line the way our outside world dey so dey careful and use your brain write topics from information wey you gather and when you won comment too.