Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Do you feel the change of leaders will make Nigeria better?
by
Gozie51
on 28/11/2023, 16:03:20 UTC


You talk well bro but I wan clear you say human being dey unpredictable because that pesin wey you think say go do better if him enter power him go surprise you tomorrow with plenty plenty nonsense wey you least expect, we get plenty beast in human form wey dey look for opportunity to wicked people and my people talk say if you wan see pesin character finish say make you put them for power.
However, waiting we dey face for this country too much only one pesin no fit deliver us and e go take I.e if only the country go fit dey produce leader wey wan give the country 60% of waiting them need at least in 4 tenure at a stretch. If this thing go fit dey possible then we go return to our normal Nigeria.
Thank you for the article


If dem agree to repair the constitution wey dem dey call amendment, leaders no get choice dan to do the right thing but if the constitution still dey as e dey, omo no way.

Na the constitution say dem go use electronic for election, na same constitution say INEC fit still use manual. That one no be double standard? Dat one no give room for rigging with INEC as we see for this year presidential election wey dem no upload results electronically and court interpret dat side of the constitution. All that na rigging wey constitution itself allow it just takes a political party to work with the umpire and the rest na story as we see for this election.

I believe self say if the constitution reduce the appointment powers of the president and governors, the craze for aspiring for those positions will reduce and those with mind to work for the people will aspire.