Why e be say for nija anything wey dey rampart especially for social media no dey genuine? How many of una Don receive the 25k conditional cash transfer? I dey ask cause anything you on your data na wetin you go dey see these days
To a point I was convinced that it's real only for me to find out say na scam...and I don realize say wen December don reach like this stuffs like this go full social media. And because of things like this now people no dey believe anything online even what supposed to help us.
If this narrative go change for we country e for better cuz I know say even if e dey real na man know man something so before e go come out public na the fake we go see...Na wa
That's 9ja for you because since way I here the information say FG dey share 25k na him I know say e no go fit rich everybody, because wetting I alserv for this country be say when something way go good everybody comes out like this you go see say na just few people way go benefits from am,but if na bad thing e go rich everybody.