Chai my people we Nigerians dey lack something and this thing nah the good good things way go help us and some of our next generation, before I talk one of the things way we dey lack, watin you think say we dey lack? For me e plenty but I want make we talk about only one thing.
Difficult to register on Bitcointalk:this nah one of the Koko way we as a Nigerian dey lack, just imagine something like this dey internet and we as a Nigerians no fit register without VPN, only this one show say plenty things dey for internet way we as a Nigerians no go fit join because of one or two issues way I Know know but of you know any reasons why e be like that click the reply icon and drop a comments, when I first observe this thing I been no won talk but not untill today.
Op, you know say Oyibo people no dey like people wey no dey straight forward for life. E fit don be say our past users from Nigeria don too break the rules and regulations of this forum, na in make them don put us where to pay for evil anytime we create a new account.
oyibo dem just keep this updates to dem self, and if person no use VPN no way to take get any of them.
This update dey accessible to anyone who knows about it, and no be Oyibo go come to tell you to join the Bitcointalk forum because them no dey see for eye, na only your Nigerian friend way get the update go fit show you.