Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Wetin look genuine no genuine for nija
by
Stable090
on 05/12/2023, 22:04:26 UTC
Why e be say for nija anything wey dey rampart especially for social media no dey genuine? How many of una Don receive the 25k conditional cash transfer? I dey ask cause anything you on your data na wetin you go dey see these days
To a point I was convinced that it's real only for me to find out say na scam...and I don realize say wen December don reach like this stuffs like this go full social media.
I see person dey post am for status too, but I no even trust the person wey post am, I dey reason say na scam so I no even open the link make I even see how e be like, but I come dey surprise recently wey one person create thread about am say him receive the 25k, and I ask the person make him drop procedure on how we go run am but him never talk anything, but if him no receive, the person no go just carry fake news enter forum like that now, so maybe some people don dey get be that, but we know say na just few people go get am.

Also make we dey careful now ooo, even if original link wey you go use register dey, make we know say plenty scammer’s go wan take advantage, they go want create fake of the link just to get peoples information just to scam, so make we dey careful ooo, no just click and start dropping your informations on any click which they claim say na him be for d 25k.

If this narrative go change for we country e for better cuz I know say even if e dey real na man know man something so before e go come out public na the fake we go see...Na wa
Na y we suppose dey careful be that ooo, na just d fake go full everywhere now, but I see say person talk say him don receive, make we wait see how him take do am wey him receive the money, since him do run am before and e click for am, him go still get the link wey him use that time to apply.