Why e be say for nija anything wey dey rampart especially for social media no dey genuine? How many of una Don receive the 25k conditional cash transfer? I dey ask cause anything you on your data na wetin you go dey see these days
To a point I was convinced that it's real only for me to find out say na scam...and I don realize say wen December don reach like this stuffs like this go full social media. And because of things like this now people no dey believe anything online even what supposed to help us.
If this narrative go change for we country e for better cuz I know say even if e dey real na man know man something so before e go come out public na the fake we go see...Na wa
You don already talk am, anytime festive period don dey reach like this, na this kind things dem dey always happen. But anyhow the matter be we go extremely dey carefully expecially this period because scammers dey everywhere dey find how who go fall enter there trap. Our Nigeria youth dey smart but them dey always use there smartness for the wrong way. Instead of to use am to become productive.