Yes some how I agree with them because a lot is going wrong in the country
This is Nigeria were you see animals eat money, Nigeria is a place people do a lot of things bad roads and corruption has taking all over, but still on still as the matter be we all still dey believe on change of the country, come wetin u think?? u don ever think am
No be lie way you talk but based on this topic, I go say me I like am say I be Nigeria, why because the reasons dem plenty but no be say I dey happy say this our good country dey like this o but how many go do? Anyway, nah to just dey depend on God for the final day when the country go change for total good.
As we dey so, we no supposed to dey put all our hope for government,,, watin I mean be say like we way be students now, go just put hope say if we graduate from School we go see government work work but e no supposed to be so. At least, when person dey go school, em suppose to learn skills even if say nah one so that if work no dey, em fit use the skills way em get take support em self.