My country people una Weldon oh
I say make I ask this question because e done de my mind since and although I de assume the answer to am, i say make I get legit answers from my snr men here.
Na about the ban on bitcoin by our government.
I want ask, what if the police or all those uniform men check my phone for road come see say I de into bitcoin, e de possible say them g reason my matter?
I de ask this question because sometimes I go de very comfortable de check out stuff for the forum for road and e go just come my mind say as police take de worry street boys and e come be say de done ban bitcoin, say de fit just harass or arrest me one day oh.
Abeg make una help a brother.
The only advice I go add here be say u gaz avoid to press Fone for road even when you dey close to check point area's and also the way you take dey Waka even if police stop you let's say for no reason just dey moderate. Me dey press my phone and na when you don't know your rights ni them go use you chop for this Naija we dey so.