Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Over use of opportunity
by
Gozie51
on 10/12/2023, 16:14:24 UTC

Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una


Like you say no be only transportation. The thing cut across all the sectors of Nigerian economy. If we look into fuel now abi kerosene or diesel. We no go even talk of people wey dey sell goods self because them too follow dey take advantage that na why I talk say the thing spread for everywhere. For example now if filling stations hear now say government want increase price dem go stop to sell and wait for the new price and before you know am dem go begin sell old cheaper price for new costly price. But if government say price drop, dem go still continue to sell old fuel for that price wey e dey before government announce price reduction.

So na government matter be this. Government suppose put price regulation to dey active and checkmate some of these extortions.