Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Over use of opportunity
by
Tuclikk
on 11/12/2023, 22:43:35 UTC
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una
To be sincere we Nigeria's we always put all the blame on our gov't which is not always right because we self are to be blamed at times. There are many things which we do most especially about this uncontrol price of a thing. na we dea kill each other sometimes. Abeg this money racing dea much if Una no forget if you do good you go see good.