This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una
If to say na for another country I will be like the matter shock me but as far say na naija nothing is like a surprise to me, we naija dey always carry every opportunities like say we Don make am for life, as you dey talk about this Buse own you no remember that time wey cashless policy dey? That time na the time wey nobody fit forget am, those POS people show us shege by that time oh, if you want to withdraw money wey you get na big problem, in fact na you get your money that time but na you and the POS go share the money because 10k charges be 4k or 5k, that time if you want to withdraw they will still be saying if you don't want to withdraw make you dey go, so this your own no be new thing for naija.
Na our government dey cause all this thing's because if them they do the right thing nothing will be like this, commercial Bus driver they do shakara dey tell passengers say if them no wan enter make them go, na their time na make them dey enjoy, after thing's become normal now their eyes go clear, because every opportunity no dey last if you no manage am well.