First of all thank you for bringing this issue come inside house so we fit trash dis issue.
I want all of us to know say if we paint ourselves ugly picture outside, na so dem go take dy look all of us wey get naija blood. abeg most of this oyibo dem no see us as anything, dem believe say dem better pass us which we , we know say na lie, naija no dy carry last for anything, even though our government dy rubbish our economy, e no mean say we go dy campaign am give person wey no belong to the family abeg, just as the op don talk already, make we no carry desperation and hustling for merit take spoil ourselves give this people abeg.