The way I vex after seeing that post Omo na only God knows I swear. I thought it was in our local board sef when I received notification for telegram but clicking on the link, na general board e take me to. I was like no no no be Nigeria person post this but impersonator disguise as a Nigerian. Even for this our local board, that kind post no necessary at all talk more of public boards. That guy really shame us for here. I don prepare my response but the thread was locked before I should finish with what I was doing. God really save him because make I no lie, na fact I go tell am if he like make him vex.
The painful part be say the guy no dey remorseful at all for the trash wey him post and dey even insult people wey he suppose learn from
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5477748.msg63320498#msg63320498 imagine justifying nonsense with nonsense boldly. He's not ready to learn from his actions in that thread. Nigeria is not the most poorest country and we should not be painting ourselves as the poverty headquarter in public domain. I don't want to mention names but people from some countries are very desperate in signature and bounties than the way we Nigerians dey run our affairs here.
To everyone wey dey introduce people come this forum, abeg make una dey take time to guide them so we no go dey see such embarrassment because I no too blame that guy but the unguided friend wey him talk say introduce him here. Even thou na merit you dey look for, you no suppose downgrade your fatherland for personal gain. There are other ways to earn merit without disgracing us before the whole.
Lastly, make the guy post apology under this thread because we deserve it from him or her and delete that disgusting post. Locking the thread is not enough because e go dey break my heart if I waka jam am anytime. I'm very disappointed in whosoever is behind that account.