Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fear for Fintech banks
by
Tuclikk
on 14/12/2023, 21:59:05 UTC
Na so every time I go get rumour say all this fintech banks wey be our greatest opay, kuda, palmpay, and all of them wan shutdown. en don become play play something, na so some people don they remove all their money. One man one time like that say e no Dy put more than #10,000 and immediately en put am en Dy go withdraw am. Another person say e no Dy allow e money stay overnight inside the account say en no trust Wetin fit hapon for night when en Dy sleep.na so others they call am online bank, say M.M.M  don do them something so anything wey come from online Dem no go put head.
Me my self I get opay, moniepoint, and palmpay but I  no Dy fear becos I know Wetin be N.D.I.C. mean.
Make them stop all this rubbish those banks they really help us o.

You know say one thing with this naija wey we dea immediately rumour start to spray everybody go wan add something on top. You as person wey go school how you go see something wey be say their license na from N.D.I.C you go say they go rn with your money chai, op you no this people wey dea fear, be like say dem do one or two with the app wea be say payback go dea, if not how dem go chop your money if no be loan you collect. This moniepoint, opay and kuda even na transfer you do wey no do, dem dea reverse your money back. Even normal bank dea do da one ? If no be say you go complain and fill form before they go rectify your issue you fit wait until 3- 7 working days, Let be sincere.