Na so every time I go get rumour say all this fintech banks wey be our greatest opay, kuda, palmpay, and all of them wan shutdown. en don become play play something, na so some people don they remove all their money. One man one time like that say e no Dy put more than #10,000 and immediately en put am en Dy go withdraw am. Another person say e no Dy allow e money stay overnight inside the account say en no trust Wetin fit hapon for night when en Dy sleep.na so others they call am online bank, say M.M.M don do them something so anything wey come from online Dem no go put head.
Me my self I get opay, moniepoint, and palmpay but I no Dy fear becos I know Wetin be N.D.I.C. mean.
Make them stop all this rubbish those banks they really help us o.
Na waiting go spoil the name of this banks some people dey do, all this banks have help us no be small, although I know say all This banks are online banking and we no dey see them like the other banks but waiting this banks Don do for us some banks wey we know more than a year's never do am, this banks are very strong and sharp when it becomes transaction, them no they waste time like others banks wey be say if you wan do transaction and money hang you go go bank go complain, this online banks no need to go anywhere you go just make call and everything is fine.
I dey even hear say our government say them go ban this bank's because them no get branch, and according to the news wey I hear them say on 15th of this December them go ban am and we dey December 15 now and nothing happen, all this bank's can not be ban at once because many people now are using it, and I think it is because them they get customers pass all this our former banks na him make them wan ban am, nothing we no go see for this country.