Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems
by
Marykeller
on 15/12/2023, 19:52:17 UTC
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
Em don d like sae d more we begin not to say much about the newbies wey d enter the forum, the more they begin to talk out of point wetin no go  follow for the forum due to nobody the direct them on wetin d suppose not to post for the forum.

At times the kind post wey I d see from newbies wey identify themselves as Nigerians for this forum, d make me the wonder who d invite them come for this forum whether dem the nurture them properly on wetin d supposed to the post or not for the forum because peso no fit just wake up to create post and begin to generalized am like sae btt d serve as blessing give unemployed Nigeria youths. Like sae 200(unverified number) wey we d for this forum na all the Nigeria youths be that or em wan talk sae Nigeria youths d 200 for population. Anyway, we no go blame am sha cos the forum d open for everyone to post as em like but that one no mean sae we no go correct and caution them when they go out of lane