Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
Op this one be like say you no water the first one wey you plant and you con get lucky say some grow and the second time wey you con plant you give ahm water na why e grow.
This one show say you no give am water or maybe enough water na why the first one no grow well. That one mean say you try to make it right this time around, For giving the plant enough water of their satisfaction.
And for the Bitcoin matter you know say if you go invest in bitcoin you gaz make sure say you dea ready for am because no be fast money e go bring but if the money com e fit change your life entirely, and the investment is all about Risk you fih gain or lose but always we dey pray for good result.