Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
Na waiting some people do not want to understand be that, as you take plant okro for the first time you see say some of them no grow, you refuse to give up, you said you should give it a try to plant another one, because you know say people have been planting the same okro and their own they grow, you realized say you no water am well for the first time, you now right your mistakes, no be everybody they ever understand that nobody sabi am finish for this life, we need to learn from our mistakes, if we try for the first and nothing turn on make we no give up we should give it a try again, person wey no lose anything no dey gain anything.
Some of us na waiting they kill us be that, if we try invest in other coin before that we no succeed, we no suppose give up to see bitcoin as the same thing that we go lose money if we invest in it, because i believe na waiting they stop many people wey never give bitcoin investment a try no be say them no get the money to invest, but they have lose money in some other investment they try before, no be only in bitcoin investment any positive things we are trying to do wey go change our life we no support give up on am, we should keep on trying one day we go succeed that is life.