Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
I like dis example wey you give to explain about bitcoin and na d perfect example wry you fit give to illustrate how bitcoin investment take dey work. Dis am just about perseverance, patience and not losing hope in what you want to do. No be everything wey you put mind to do dey work out at first when you start am, sometimes drawbacks dey plenty and dos drawbacks na to guide you for the picture ahead of you so dat you go know how to tackle dem when you reach dat stage.
All of us don see how bitcoin don grow over the years and we really wan make the good part of it too as people don make in d past. But even dem too, dem pass through dis stage wey we wan pass too now as dem dey invest and if dem dey faint hearted dem no for comot today dey give good testimony of how their investments go for dem to come yield good profit. Everything for life na jejely and if you wan rush without passing the due process, you’ll fail and give up easily before making it far.