Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Scam alert,,,,, Confirm before doing anything.
by
SmartGold01
on 19/12/2023, 14:40:39 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (2)
My pipo, Una good evening oo, e get one kind of thing way scammers them take they scam people this days, and I know say some of us here go done they aware of am and many people too done fall victim for those kind things them.
The thing be say, them go call you con tell you say somebody for una or a member of your family dey sick seriously and em done rush am go hospital and the doctor say if Una no deposit money first em no go start the operation.

This their format self no pure because no way person go call you and immediately just send am money, although person wey i know don chat me for media say she dey down based on my school friend those days and she was my closet and wetin i just do be say i asked her to send me her account number since i sabi her well and as she send her name corelate with the details she sent me. This alone con make me know say sometimes scammers dey use person wey una two be friends for long dey enter person but i still call her and chat her up on whatsap to confirm weda na she be that.

Like for this one wey you talk na true because dey some people dey behave when dem hear say dem mama or dem papa even their brothers dey sick bed dem go do like say dem wan die, but so far if i receive such call knowing say for days or weeks wey i speak with my people no body don tell me say any person dey sick and if i receive such calls i go just end call put call across hom to know weda any person dey sick or not talk less of rushing them to hospital for operation or anything else.