Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
Scam and hack 4 9ja
by
Mia Chloe
on 21/12/2023, 08:27:16 UTC
My contri pipo I greet una oo
Many many times I don see pipo way lose dem funds to scammers and hackers dem.so dis matter way I wan Yan so go fit help us.
To de take start watin b d difference between hacker and scammer?  Now many many times pipo de mistake hack and scams matter but true true Dem no b d same.


HACKERS
Now hackers dem de tif pipo data like card detail, Dem logins, location and many many other tins.now how many of dem take de work? Dis hackers Dem don upgrade well well as time de go .most of dis hack way Dem de do na phishing. Now 4 pipo way nova Fe hear of phishing make I explain am .dis phishing na method way Dem tay de tiff pipo details. 4 dis phishing matter hackers go create fake of beta company way ge level come use am as link take tiff ur data.4 example wit dis phishing  hackers go fit create fake Facebook page com send link give u and wen u click am come fill in ur data press login, all dose detail go send give Dem. Some of Dem sef de use some software take de monitor ur fone once u click dose link .with am dem Go fit get beta information from your fone take tif you. To take avoid hack some of d tins we fit do na ;

  • Avoid spam emails; many hack way Dem de run na through phishing link and Dem Dem mostly de send am go pipo email, text or even deir social media accounts. So de check if any link na phishing link b4 u click or open am.
  • de use official tools ; many times pipo de like install mod app or software enter Dem device and dis matter no clear bcos dis apps fit get back door from dis hackers Dem to take tiff ur data.
  • mind d kind site u de visit; dis one de very Important. Many pipo de visit different sites way no clear even wen deir device de warn Dem. Many of dis site de carry malware way fit infect ur device.
  • de careful of permssion ; many time if we de install apps we go just de press yes yes do go we no de read d kind permission way d app de ask sometimes b4 we grant am.And no b so e suppose b. So make we try de read all dis permission and de cancel d ones way no pure.
  • de read article; dis part don help me well well personally. Make we de read scam and hacking tactics from time to time as e go help us no how to take notice am quick b4 e de too late.



SCAMMERS
D scammers Dem de different one kind . Now scammers na pipo way go come meet u with beta offers to take cover ur eye tiff u .e no b like hackers way de tiff ur data but u no go no scammers De juns u collect ur data. many of us sef go don experience dis pipo 4 social medias .some go bring offers like say Dem wan help you, some go even call u de claim say Dem b bank pipo and many many others. But d big question b say hw we fit avoid all dis pipo.

  • De contented ; d reason y dis scammers de catch most pipo na bcos Dem get open eye. Most of Dem de fine quick moni way go de easy.
  • mind hw u de share ur contact ; I don notice say many of dis scammers Dem de get ur contact from groups  especially 4 WhatsApp. So try de avoid contact gain matter way most pipo de like do 4 WhatsApp
  • de updated ; always de try get info of new new scam matter bcos many of dis scammers de bring New format day by day ,bcos sometimes we need understand dis Dem tactics make we 4 fit avoid am. Remember say information na power
  • no de rush! ; many times if dis scammers wan trick u tiff ur data Dem go make am  b like say na urgent matter make u 4 lose guard give dem ur info. So make de take time check for scam if we de deal with pipo especially online.
  • de careful ; to take avoid scam everytime we need de careful on how we de share our data especially 4 social media.
  • de report scam ; sometimes if we notice scam we go jus ignore but nor b so e suppose b. So make we try to de report Dem as e go help cast their format or the social media fit block Dem.

Abeg my pipo make we de careful oo bcos e no de sweet at all if pesin lose e moni.