my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them