For our brothers and sisters wey dey stay around eleme or wey get person around there make una confirm this matter,because like this I no believe anything wey dey comot from this government dem mouth. And person just ask me this question this morning based on say I be Rivers person but I confuse I swear.so may Graduates needs job and dey wait to get update so dem fit put head of available openings..
I hear am from person mouth yesterday, but the person talk say na till next week before e go start work fully, actually as I hear am me I no carry am serious because I no even believe the person, but as you come post am now, like say the news don dey everywhere be that ooo. Make dem start work early, at least make fuel price Sha come down, to dey buy fuel 650 naira don tire person jare, let’s just hope it’s true and make fuel price come down.
Even if dem go employ people e no go too plenty like that, d refinery done dey since, no be new refinery, and dey get staffs wey dey collect salary even as e no dey functional, na those people go continue work now, na just few people dem go need employe. If na new refinery wey dem just dey build, na him I go talk say massive employment suppose dey like that Dangote own, but no too put mind say dem go collect plenty people for that porthacourt own.