Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Abeg Na true say say porthacourt Refinery don start dey work?
by
Spaceman1000$
on 22/12/2023, 18:48:32 UTC
For our brothers and sisters wey dey stay around eleme  or wey get person around there make una confirm this matter,because like this I no believe anything wey dey comot from this government dem mouth. And person just ask me this question this morning based on say I be Rivers person but I confuse I swear.so may Graduates needs job and dey wait to get update so dem fit put head of available openings..
Omo I see for news say the refinery don start operation but I no know if na eleme refinery or Abi na the port Harcourt own, but I no really put interest for the refinery matter because say, presidential spoke person talk say wether we refine the product locally or we import am, the price go still stay the same, Omo that talk pain me well well, i no come send if the product them refine am for Nigeria or not. Because watin the need to come tell us the say local refinery don dey work when we cannot get the product at a cheaper rate.