Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: SAFETY TIPS FOR THE YULETIDE SEASON
by
Mimiklinton
on 23/12/2023, 18:06:40 UTC
Op thank you for this tips, them dey very necessary for us, apart from now sef we suppose consider all these tips make we for no go create problem for our self, especially the drinking part, this season na soso celebration we dey see, na now some street sef they feel like to do carnival party and Beach party, so make we mind the way we dey drink outside, no be everybody like you, if you wan go piss cover your drink well or no go piss until you finish am, because most times people wey we think say na out friends, na dem be the demon wey dey torment our lives. And them fit dey plan to kill you sef.
Yes o,that last part to cover drink dey very essential,many persons don die by that form of poisoning.and na only person wey dey close to you fit poison you.
In General as we dey jolly make we no no loose gaurd,so we fit come back come continue the hustle for next year.