Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: SAFETY TIPS FOR THE YULETIDE SEASON
by
Obim34
on 24/12/2023, 00:31:05 UTC
Op thank you for this tips, them dey very necessary for us, apart from now sef we suppose consider all these tips make we for no go create problem for our self, especially the drinking part, this season na soso celebration we dey see, na now some street sef they feel like to do carnival party and Beach party, so make we mind the way we dey drink outside, no be everybody like you, if you wan go piss cover your drink well or no go piss until you finish am, because most times people wey we think say na out friends, na dem be the demon wey dey torment our lives. And them fit dey plan to kill you sef.
Like this u jess talk wetin dey my mind for this covering of drink. For this festive period like this man no get to loose guard if not man go collect wetin no good. As dey no dey write bad person for head we go need to dey very careful even that person wey we feel say na ur good friend na him fit plan am, so like this e don be call to every body to dey careful as we dey eat and drink, FRENEMIES plenty.