Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
by
Mpamaegbu
on 27/12/2023, 16:16:39 UTC
⭐ Merited by Igebotz (2)
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note.
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.