Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (
No African local board) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.
If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.
We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.