Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African Proverbs in Pidgin
by
GiftedMAN
on 02/01/2024, 15:23:20 UTC
What goes around comes around.

Zillamos, you go try step up your game nah, as you don try locate this our corner, first of all you need to start from the beginning read and learn from wetin oda people write so  you fit learn from them. This corner na African proverbs in pidgin, wetin you need to do na just to write your proverbs in pidgin then you fit use big big grammar come interpret the meaning of your Proverbs.

Make I also use this medium advise you to stop to dey drop one one line write up e rit no worry you now but later e go fit affect your account, you fit gum body with person wey show you dis corner make em fit give you small expo on how this area dey be or you just take small time go round only our naija board make you fit observe how things dey go here. No forget say pikin wey go sabi something no dey waste time take correction so try sleep four side make you observe as things dey go.