Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??
by
Hatchy
on 02/01/2024, 15:42:52 UTC
⭐ Merited by Mia Chloe (1)
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job. For some parts of the forum u go see as some top oga Dem dey use mouth Tay finish some low rank account and person wey no get patience go fit vex talk back or just reduce e post for forum.

Normal if u no strong for here u no go fit grow na d truth just be dat. Again, some newbies fit don get wrong information about d forum, wey make Dem rush con register. Dem go don tell Dem say money dey here and if u fit grow account u go turn millionaire over night. all these many many wrong information na e dey give the newbies Dem wrong motive to tay join forum and u go see Dem just pop out, dey post things wey no make sense or some go come dey spam forum. Once Dem criticize that kind person, e go just rest and e interest fit just die like that.

 As I dey grow from newbie, I don learn many way, to tay endure this forum and no one method na to over look nonsense talk from some members. If u see person wey talk black lash you for ur post, just leave the post or if u see say watin e talk correct but e still talk spoil wey be like insult, tell am thank you then commot from there. Nobody go fit kill you physically for here na internet we dey and even though e use mouth finish you, e no go fit affect you so make we try dey chill.