Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is English language really necessary in our local board?
by
Stable090
on 02/01/2024, 21:25:10 UTC
Though for me I prefer make we use pigin as official language so that e go help those of our people here wey no too know how to speak correct English and when e be say if other people dey speak correct English Dem no go understand wetin Dem dey talk so that e go dey easy to carry everybody along for d local board.
Dey don talk about dis your topic before now, na why dey come up with a suggestion say make we dey use both English and pigin for here, and I see say na better idea, anybody wey no understand pigin, then make him use English, you self wey write dis post, I see say na only English you use, if you are fighting for pigin to be taken as official language here, then you for don use pigin write your post now, but na English you use. We no suppose make d forum hard for each other, no be everybody understand pigin like that, so if you make pigin dey mandatory, then plenty people wey no too understand pigin no go dey post for here.

So as we don make English and pigin official language, if you no sabi pigin, then make you use English post, and if you no sabi English, then make you use pigin dey post. I dey sure say if you dey join dis forum you go understand at least one of the languages wey we agree to dey use here.