Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Topic OP
Dangers of the internet
by
Brainiac01
on 03/01/2024, 02:12:43 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
e just dey scary how 99% of the world's data dey on the internet. Even our incognito(private browsing) data sef dey on the internet with our digital fingerprints. Me and person being dey discuss how easy e dey to actually track anybody for this earth as long as say the person dn active for internet before. if no be say some laws dey cover how this big tech company dey take collect our data, some of us wey think say we dey untracable for dn go jail sef. Everything about us actually dey internet as of now, even your "view once" for whatsapp sef. Infact any things wey you thinks say you delete still dey there only say you no get access to them again. Just dey careful of things wey you dey post for internet.