Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
The effects of NEPOTISM (MAN KNOW MAN) in Nigeria
by
KupaCrypto
on 03/01/2024, 05:24:06 UTC
Nepotism Na simply when men wey dey in power or position favour their people over the general interest of Nigerians, Nepotism Na weitin we dey call MAN KNOW MAN, like we all know say this country even as work no dey e get people wey dey get work steady, most of them self even when them still dey University them done secure work for them bcos there person dey in power or authority,
Nepotism fit cause plenty damages for the work force of any country, because the  employment Na by who you Sabi and no be by waiting you fit do, most times the relatives wey dem give the job no know anything concerning the work but because they just want am to chop money them employ am,

Some of the effects of NEPOTISM they down
1. E dey reduce the work reduce work performance with unqualified employees wey no get that job experience at all.
2. E dey make the country relatively unproductive in some areas for the economy
3. E dey make people wey actually know the work well not to get job, so e dey lead to unemployment most times.

Nepotism no suppose dey any country, bcos some jobs need required skills and specialties no be by man know man,