From my own side I go talk say the two of them na actually prediction because even after you dn run analyses you no really dey sure of anything. I dn ask people wey dey into forex but some dey claim say e dey different. If you get idea about the two i go like know if anything really dey different for the two of them
My brother the two from one sense na actually same but the difference is that one is more hype to thinking that you can actually make a living out of it while the other one na purely luck business. For me the two of can be related to luck and stats, although many people believe say you fit use same stats follow up gambling but my brother I tell it's not easy and I would advise sef for anyone wey no get watin dey give am money to actually avoid this method because these two things need proper and strick income because you fit turn addict if you say you wan carry for head.