From my own side I go talk say the two of them na actually prediction because even after you dn run analyses you no really dey sure of anything. I dn ask people wey dey into forex but some dey claim say e dey different. If you get idea about the two i go like know if anything really dey different for the two of them
You dey wrong for comparing this two because dem both involve risk no make dem the same thing. You Sabi forex? How about gambling? If you sabi both of them, dem no need to tell you their differences. E sure me say you no sabi dem sef cux no be bet9ja you suppose use for your topic but rather gambling instead.
Although, both of them get risk wey go make person lose his money but the difference between forex and gambling dey obvious. This two things wey you dey compare dey work differently because first of all, forex trading na legit business but gambling na for entertainment.
Forex na some thing wey you go use your knowledge and the skill you have to execute but gambling na based on luck. Na why people dey pay for forex class and tutorials to learn but you don ever see person dey pay to learn gambling before? I'm very sure, you never see. The thing be say make you no put body for any of this two if your mind no strong because e fit make you regret the day wey dem born you. I don try the both before and I know how dangerous they can be but forex is more reliable if you go fit take your time to learn very well about it.