E nor easy oo, I believe say any decisions wey we take now for ourselves so weda na good one or bad one e go surly affect us either positively or negatively. I no blame Laszlo for using that amount of Bitcoin take buy pizza, because only that deed sef naim help prove say Bitcoin na legit coin at that time. Nobody go like carry money go o buy fake something wey nor dey work, but apart from him, I believe say many other persons sef go don use huge amount of bitcoin take buy wattin no worth the amount of bitcoin. But if only say them see am as investment opportunity rather than just digital currency e for good well well.
I will suggest creating an avenue where cryptocurrencies and it's importance is being thoroughly emphasized on to these persons that doesn't know the importance of cryptocurrencies (Bitcoin precisely) and some other valuable coin.
I think now wey government don remove the ban from Bitcoin and other crypto some persons go use that opportunity take they do tutorial to make small cash from teaching people about crypto, how to trade etc, already we get some forex trainer for this country so Dem fit even add crypto join their scheme. Place like El Salvador wey Dem don dey use an as legal tender since, I believe them dey teach am to those wey nor know about am.