Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Dangers of the internet
by
Makus
on 08/01/2024, 16:57:28 UTC
Nothing comot for everything wey you talk. technology dey advance and naso e dey bring more harm to us even thou say e dey bring good but the bad Side of it dey Hunt us down. Posting things on internet na something wey be say e do. Turn to peoples way of life. Which dem no go fit do without am. But we still need to be conscious of the things we post like documents wey contain property wey worth a big amount of money because if them hack a document wey you upload online like Gcloud or any online privacy app. And you think say e dey safe, if them hack that online account everything is gone. Just like my Facebook account wey I dey always upload my photos and that if my baby, thinking say e go dey save for there since na internet say e go dey safe from rat or termites eating the pictures, to my greatest suprise them hack my account 2secinds all my data finish na White man wey I no no before come full my profile. So that one na another lesson for online upload experience wey j get.

Na the ogbonga matter naim you don Yan so, the set of persons wey I dey pity pass na all those people wey think say dem smart come dey go save their seed phrase for Google drive or any other online software. Anything wey make hacker fit get access to your email make you just know say your assets for you wallet don go be that. Naim make the best and cheapest way to store your seed phrase na to write am for paper. Facebook no dey safe at all to even save our pictures because, minus say person fit hack am, immediately you post your picture for Facebook, your picture quality dey drop asap. Though for memory sake I prefer google drive to take save pics but that one no mean say  e dey 100% safe.