Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: POWER OF CORRUPTION
by
Pi-network314159
on 09/01/2024, 22:51:15 UTC
People dey always dey talk say power corrupt, power corrupt, yes most of us don talk am before, we dey think say na power dey corrupt person but the truth be say most of us already get corruption inside of us we only need the opportunity (power) to bring out the corruption in us. A man once said if you really want to know the person true self give him 3 things: Money, Power and Access to Sex. With this 3 things you can know any one true nature. So no be power dey corrupt, power only reveals corruption.
Them don talk this matter on several occasions say money dey only unmask person but e no dey change person. Every human get an inborn carracter but then no dey show am out except say something happens before you go know wetting dey are made off. So just like every body get gull blader wey dey make person Angry, naso e also be for corrupt mind. Wetting go help that kind mind na self control. Because if you no learn self control, na your emotion go rule you.