People dey always dey talk say power corrupt, power corrupt, yes most of us don talk am before, we dey think say na power dey corrupt person but the truth be say most of us already get corruption inside of us we only need the opportunity (power) to bring out the corruption in us. A man once said if you really want to know the person true self give him 3 things: Money, Power and Access to Sex. With this 3 things you can know any one true nature. So no be power dey corrupt, power only reveals corruption.
Op this your matter how I want take explain naim it longooo, I dey hear when people they criticize people on power some time I will laugh because person wey dey watch match naim they see players error past even the player. Just put the person wey dey watch and see his mistake go triple you wey him condemn waiting power they do strong oo example we naija they shout make the youth rule ,leads just look at one of the youth on humanitarian minister how the matter be as power enter. Corruption is just like blood why power is the heart pumping the blood for curruption to cease when power is involved is like the person in power have killed the heart through integrity and degnity any more than integrity make curruption dominant.