People dey always dey talk say power corrupt, power corrupt, yes most of us don talk am before, we dey think say na power dey corrupt person but the truth be say most of us already get corruption inside of us we only need the opportunity (power) to bring out the corruption in us. A man once said if you really want to know the person true self give him 3 things: Money, Power and Access to Sex. With this 3 things you can know any one true nature. So no be power dey corrupt, power only reveals corruption.
Op as you talk am na so e be, power no corrupt, na people naim corrupt. Because the same power wey Dem give Hon Dickson wey make am owe people salary for over 3 months, naim Dem still give Hon diri and e never own one single months. Na just who you be naim you go display if power enter your hand. Some persons go use am wisely while other go try to use am manipulate the system to their own favour. Na true say power sweet but some persons dey wey be say power no go fit controll their behavior at all, the way Dem dey from start na so Dem go still dey after they have been induced with power .