Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Life is precious
by
Makus
on 13/01/2024, 18:20:03 UTC
Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
Normally,, no be she be the only person way life done show shege, I believe say one day table go turn for everyone way dey do legit hustle, so for a person to take his or her life is something that's not good in the eyes of many and in the ears of anybody way go hear ram.
As long as say person dey work and and em no dey dey hungry, em suppose to thank baba God because many other people for some locality dey find any job way to fit dey give them even if say nah 10k per month them no dey see and even good them no dey see but them still dey alive till today hoping say one day things go change for good.
As I read the news I just tyre because no be better thing way the woman do to her self because as she done pkie go now even the money she no get, so nothing still change.

Na now I just dey see the post of the lady wey go kill herself, to me the excuse wey she give no dey worth killing herself. Just because she no dey do well. But the most important thing na be say she been still dey for the bank dey work as marketing staff, Dem never even sack her naim she dey go kill herself. Now she go just leave her papa, mama and siblings with tears for their eye. Infact nothing for this life worth killing yourself for, because where you think say your own bad, you go definitely see person own wey bad pass.