Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Petroleum price
by
DaNNy001
on 13/01/2024, 21:51:02 UTC
What is the faith of Nigeria's in the price of petroleum in 2024?

You deh worry about fuel price for Nigeria, you know how much diesel and kerosene them be. Abi na cooking gas own we go talk? Those ones deh more expensive than fuel weh you deh talk self. This government and hardship for the masses na something else. Our people are suffering. Na God go save this country so.
My brother things dey spoil every blessed day by day and I wonder if a go actually get time wey all these hardship fo stop because like the country don condition so many to adjust their way of life and the one way dey pain again na the price of dollar wey dey rise every day by day and nothing wey our government dey do to actually fit this high of the dollar against our naira although many people wey dey here fit dey pray make the dollar dey rise as dem dey get funds as dollar but dat go be selfishness because the rate of people way dey suffer plenty pass you wey no get problem.